Friday, 10 April 2015

Yeeeee!!!!!



 E get one particular restaurant wey I dey go chop for G.R.A. and e get dis oyinbo wey dey always come chop there too. Anytime this oynibo chop finish, he go shout ''Hey'', so I wonder wetin dey make am shout. I come decide to chop wetin the oyinbo dey always chop so maybe me sef go shout too.
When I reach d restaurant yesterday evening, I order wetin the man dey chop. Dem tell me say na chicken & red wine, so I chop am finish, I no shout. I collect extra plate, but I no still shout. I say this oyinbo na mumu o, wetin dey make am shout like dat? Na so I just vex ask for my bill. The waiter tell me say one plate of chicken & red wine na N75,000 then the extra plate too na another N75,000. Na then I shout hey! heyy!! heyyy!!! Heyyyyyyyyyyyyy yyyyyyyyyyyyyyy yyyyyyyyyyyyyyy yyyyyyyyyyyyyy yyyyyyyyyyyy...
........
Up till now, I still dey shout ....

#KipSmiln’

No comments:

Post a Comment